Nigerian cryptocurrency: CBN ban Crypto [Dogecoin, Bitcoin, Ethereum] trading in Nigeria as China, India, Iran ban crypto-currency trades 9 February 2021

Nigerian cryptocurrency ban wey Central Bank of Nigeria [CBN] announce to stop trading in Crypto [Dogecoin, Bitcoin, Ethereum] no dey new. Yes! e don happun before for oda big kontris around di world.
Nigeria Central Bank on Friday stop banks and financial institutions for di west African nation from dealing in Cryptocurrency or facilitating payment for Cryptocurrency exchange - weda na Crypto coin or Crypto token. Latest tori be say one financial operator [Providus bank] don suspend virtual payment services and e dey happun just afta di CBN fresh order. Local media for Nigeria dey report say, dis decision of di central bank [CBN], na because of di warning wey dem receive from United States Federal Bureau of Investigation [FBI], concerning di activities of fraudsters wey dey use cryptocurrencies to bring hundreds of millions of US Dollars wey dey obtain illegally from USA and oda western kontries into Nigeria. Report say to avoid detection, some wayo pipo use to send millions of dollars to Nigeria through cryptocurrencies and this has make some the difficulties for the authorities for both Nigeria and US to trace the illegal money

Comments