Muhammadu Buhari: Key tins Nigeria President 2021 New Year's Day speech 1 January 2021 New Informate 2 January 2021

As Nigeria dey follow di rest of di world dey enta new year of 2021, di kontri president Muhammadu Buhari don address di nation for national broadcast. For di 19 minute speech, Buhari sharpaly tok say true true, 2020 be one of di hardest years wey NIgeria don see based on di way di coronavirus pandemic affect di economy. Di presidio tok on national sovereignty, insecurity, Covid-19, corruption and di economy. As we sabi say 2020 na very tough year, dis year test our national resilience and ability to survive dis tough time plus e give us renewed hope say we fit face any storms wey dey our front for 2021 and beyond". E follow rememba pipo wey no follow make am enta 2021. Di president also touch on di mata of national unity and e tok say Nigeria go survive and thrive. "We gats rememba say we celebrate di historic occasion of our sixty years as independent and sovereign kontri on October 1st 2020.

Comments